Just saw this!
According to wikipedia, the official language in Nigerian is English but we all know that the common language we speak in Nigeria is Pidgin.
Nwanne be proud to speak your pidgin whether it is the simple pidgin or waffi pidgin, that doesn’t stop you from speaking good english when you want to.
Anyway make I cut my tori short, here are some warrified proverbs that will sweet your belle.
Man wey Unclad no dey put hand for pocket.
Loose translation: You can’t do somethings if there are no certain conditions.
Chicken wey run way from borno go Ibadan go still end up inside pot of soup .
Loose translation: You Can’t Run Away From Your Destiny.
Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap.
Loose translation: Keep calm! Nothing last forever.
Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef.
Loose translation: Just be patient. Let the game come to you. Don’t rush!
Akara and moin moin get the same parent na wetin dey pass tru make dem different.
Loose translation: How you start doesn’t matter,what matters is how you finish.
Wetin concern agbero with twitter handle,or malu/ cow with face cap?
Loose translation: Mind your business.
If life dey show you pepper,my guy make pepper soup from am.
Loose translation: Make something good out of a bad experience.
I get am before No be property.
Loose translation: stop living in the past and start living in the present.
If person too tey for party e go follow dem wash plate.
Loose translation: Don’t outstay your welcome.
Rolling stone, of course na person push am now!
Loose translation: There is always a reason for something.
Craze no hard to form, na the trekking be wahala.
Loose translation: Easier said than done.
No matter how hot your temper be,e no fit boil beans.
Loose translation: Calm down,your temper won’t solve the problem.
Every mallam with em own kettle,every Northerner with em own radio.
Loose translation: Every man for himself.
You no need cutlery to chop slap.
Loose translation: You don’t need my translation to understand this,lol.
Opolo eye no be open eye.
Loose translation: Having Big eyes doesn’t make you civilised,lol.
Leave matter for Mathias and Sabi for Sabinus.
Loose translation: let sleeping dog lie.
Bring suya, bring suya,…….na cow body dey suffer am.
Loose translation:Every action has a consequence.
E go better na e go better,na im make ibo man still dey Kano.
Loose translation: When there is hope,there is Life.
Escort me, Escort me, naim slave trade take start.
Loose translation: Serious things sometimes start like joke.
Na from play play dem dey form PLAYER.
Loose translation: Serious things sometimes start like joke.
Pikin wen use agbada take stat guy go talk wetin e go wear wen e old.
Loose translation: Slow and steady wins the race.
The water wey dem use take make eba can never be recovered back.
Loose translation:nDon’t cry over spilt milk.
Nearly no dey kill bird.
Loose translation: It’s either you have it or you don’t.
Fly wey no get special adviser na im dey folow dead bodi enta grave.
llose translation: Don’t stay ignorant.
No matter how lizard dey do press up, e no go get chest like aligator.
Loose translation: Be proud of who you are.
The cassava today fit be gari tomorrow.
Loose translation: No condition is permanent.
If mad man don beat ur mama before,if she see mechanic she go run…
Loose translation: once beaten twice shy.
Jollof Rice wey dey for d bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro.
Loose translation: no condition is permanent.
Fowl wey dey carry for head no dey know say to waka na work.
Loose translation: A dependant would not know the value of what he/she is enjoying.
Person wey never find space for ground no suppose dey look for mat.
Person wey borrow cloth go party no dey dance too much.
Who read na im serious, who pass na im knowbook weda nyansh face east or west, na still back e go dey.
Fly wey land on top Butter, think say im be butterfly.
Proudly a Nigerian? Oya Add yours too